E Don Shele by Victor Demaraji — Lyrics

Victor Demaraji Nigerian Pidgin English Christmas Celebrations Concert Solfa notation

Full Lyrics

E don shele o! E don shele o! E don shele o! Come oh make we go to Bethlehem, make we go see wetin happen o! Come oh make we go to Bethlehem, make we go see wetin happen o! Wetin shele o? Wetin shele o? Come oh make we go to Bethlehem, make we go see wetin happen. Mary don born for manger, Yes! Son of God. Mary don born pikin, Yes! Son of God. Mary don born pikin, Yes! Son of God. Mary born pikin for manger, so the bible talk. Mary don get belle, she come born the Son of God our saviour. Pikin wey pass pikin, Yes oh! King of kings wey we dey expect. Na for where dem born am make we go see am and adore am, yes oh. King of kings wey we dey expect. Gold, frankincense and myrrh na him we go give am, yes oh. King of kings wey we dey expect, we go give am. Oya oya oya oya E don come. Salvation don come, Jesus don come, Redemption don come. Oya oya Joli Joli don come, Joli Joli don come. Make una happy, make una happy. Angels dey sing for heaven, Angels dey sing hosanna hosanna to the Son of David wey Mary born oh. Come E don come, Come E don come, Come E don come, Come E don come. Mary make she no fear she get favour, she go born pikin. Halleluia E don come, Halleluia E don come, Halleluia E don come, Halleluia E don come. E go reign o, him kingdom no go end E no go end. Halleluia E don come, Halleluia E don come. Wetin dey go call him name? Dey go call am Emmanuel, dey go call am Emmanuel. God be with us. Government go dey for him shoulder, E go reign for ever and ever. Nobodi go fit kill am, Herod no fits him. Soldiers no fit E go reign for ever and ever. Three wise men dey hear am, dey go find am. See am dey give am worship and adoration. Give am gold, frankincense and myrrh. Dey go call am Emmanuel, dey go call am Emmanuel. Wonderful Counsellor Almighty God, Na so, Na so. The ever lasting Father, the prince of peace. Joy for the world the prince of peace the Lord don come, the prince of peace. Come out make noise make una dance for the new baby. Come out make noise and dance make noise, dance for the new baby. Dance dance, shaka shaka shaka shaka re. Dance dance, shaka shaka shaka shaka re. Dance strike your bodi, shaka shaka shaka shaka re. Dance dance, shaka shaka shaka shaka re. For Emmanuel dey dance oh, dance oh, dance oh, dance oh and dance. Shaka shaka shaka shaka re.

Download the sheet music

E Don Shele

E Don Shele

By Victor Demaraji
Solfa
Nigerian Pidgin, English
4 pages
13 Downloads
Christmas Celebrations Concert
0 0

More lyrics you may want