Full Lyrics
Something don happen, E don happen
For Bethlehem dem don born the King of Kings
Kings, dem don born, dem don born
Our Saviour, our Saviour
For Bethlehem dem don born the King of Kings
Prophet Isaiah talk say, O!
For unto us, a Child is born
For unto us, a Son is given
The government go dey on shoulder
He go dey rule us forever
Dem go call ham Wonderful
Wonderful, the Counsellor
The Mighty One, the Mighty One
Everlasting Father
Immanuel, the Prince of Peace
The Saviour of the world
The Prince of Peace
Nwa ka nwa, nwa ka nwa
The King of Kings
Mary born Pikin, she born Pikin
Na so the Bible talk
Na for where she born Pikin?
Pikin wey pass Pikin
She born ham for Bethlehem
Wetin we go call ham O?
Na Immanuel!
The gov'ment go dey He shoulders
Angels dey sing for heaven
Na Immanuel, Immanuel
Pikin wey pass Pikin
Our Saviour, Pikin wey pass Pikin
Immanuel, the Prince of Peace
E don come, E don come!