Full Lyrics
CHORUS
Oga Jesus you dey sweet me for belle
too much for me
You dey make me wander o wander o
Oga Jesus na You I go follow
up for you O Jesusi na wa yao
make you praise am make you thank am
wetin E do for me I no fit count am
Hale le Hale le Hale le Hale le Hale le
Hale le Hale le Hale le Hale le
numba one numba two numba three numba four
up for you O Jesusi na wa yao
VERSE 1
You just dey do am for me no be say I fine
My papa you be my Alpha and Omega
Day and night O You dey scater me with love
every day You give me chop
You no dey play me wayo
VERSE 2
Wetin I go do to take thank you baba
as your pikin I go give you
Day and night O you dey bless me yanfu yanfu
up for you O Jesusi na wa yao
CANTOR CHANT
Dey praise am Dey thank am
E butter my bread
Na him wey be my God
Kele nu ya tobe nu ya
Ja ya ma cho ya a ma
E korri i yin si baba
E wa la fun E gbe ga
E mu rai ra ya bo
Ku zoma ya bo
up for you O Jesusi na wa yao