Full Lyrics
CHORUS
Come o make we thank our God!
E dey do me well.
Come o make we thank our God o,
E dey do me better.
Come o make we thank our God!
E dey do me well.
Come o make we thank our God o,
E dey do me well, e dey do me better
Na im make I say make you come o
Make we thank our God.
O ya! o halele
Make we thank our God.
O ya! o halele
Make we thank our God.
VERSE 1
Wetin God dey do make you open your ear welu welu
Make I tell you tori
He give me life
He give me strong body, he give me education
He give me job.
He give me better husband
He give me house.
Na im make I say make una come make we thank our God
Na im make I say make you come o
Make we thank our God.
VERSE 2
Halele I go thank my God.
Na im wey dey make me happy
Na im wey dey make me laugh
Na im wey dey make me smaili o
I go thank my God.
Na im wey dey make me happy
Na im wey dey make me laugh
Na im wey dey make me smaili o
I go thank my God I say
O ya O ya O ya O ya halele
Make we thank our God
I say make we thank our God
Halele! Halele!