Come make we thank our God by Sam C. Ezugwu — Lyrics

Sam C. Ezugwu Nigerian Pidgin Offertory Hymns Hymns Solfa notation

Full Lyrics

Come o make we thank our God, e de do me well come o Make we thank our God O, e de do me better E de do me well, e de do me better Na im make I say make you come o Make we thank our God, Oya O halele Make we thank our God, Oya O halele Make we thank our God My people una hear wetin God de do Make you open your ear E give me life, e give me strong body, e give me education E give me job, e give me better husband E give me house na em make I say E give me pikin O, e give me house Make una come make we thank our God na em halele I go thank my God halele I go thank my God halele I go thank my God na em we de make me happy na em halele I go thank my God We de make me laugh na em, we de make me smilio I go thank my God Na em we de make me shine na em, we de give me joy na em We de make me dancio, I go thank my God I say halele, I go thank my God Halele halele halele halele halele halele Make we thank our God, halele, halele

Download the sheet music

Come make we thank our God

Come make we thank our God

By Sam C. Ezugwu
Solfa
Nigerian Pidgin
3 pages
1 Downloads
Offertory Hymns Hymns
0 0

More lyrics you may want