Full Lyrics
CHORUS
Come O make we thank our God,
E dey do me well.
Come O make we thank our God O,
E dey do me better.
Na em make I say make you come O
Make we thank our God.
VERSE
My people una hear wetin God dey do
Make you open your ear welu welu
Make I tell you tory;
E give me life,
E give me strong body,
E give me education,
E give me joy,
E give me better husband,
E give me better wife,
E give me pikin o,
E give me house,
Na em make I say, make una come
Make we thank our God.
CODA
Halele! I go thank my God.
Na Him wey dey make me happy,
Na Him wey dey give me joy.
Halele! I go thank my God.
Na Him wey dey make me smilio,
Na Him wey dey make me shine.
Halele! I go thank my God.
Na Him wey dey make me laugh,
Na Him wey dey make me dancio.
Halele! I go thank my God.
I say Halele!
Make we thank our God.
O! yes, Halele!